Wande Coal, before you self destruct…

Photo of wande coal
Wande coal

Oga Journalist: Oga journalist, you quick come back o, wetin happen?  I never finish the work o. Sidon make I sharply change the oil filter and put new engine oil make we dey go house. Oga Journalist: I know you won’t be done. No be Oga Journalist wey I don sabi since? Oga Journalist: No be so o. I wan make you drop me for my junction na why I delay the work till time wey you go close. You don hear your guy, Wande Coal, new song? The guy try for the song o, but the beat no just follow at all. Make him find better producer like Don Jazzy nah. Oga Journalist: I downloaded it but I’m yet to listen to it. Oga Journalist: Make I play am for you.  (#NP Baby Hello- Wande Coal, Produced by Maleek Berry). You no see say this beat dull this song? Oga Journalist: Errrrmmmm, you have a point. This beat lacks those type of ‘ajasa’ Don Jazzy’s beats have. But Wande did well on this song. I think the part he sang a few lines in French is nice and the ‘Mrs idikunle’ part got me laughing. Oga Journalist: bros, I know say you be Wande fan, but make I no lie you, e be like say wande’s career no dey go forward as we dey expect when he comot from Mo’Hits. Oga Journalist: What do you mean? Oga Journalist: imagine, Wande drop video for song of February 2013 in March 2014, you wan tell me say Wande never record better song wey hit pass ‘My way’ wey e fit shoot video for since last year February? Oga Journalist: He’s probably saving those hit songs for his second album. Oga Journalist: You don dey fall my hand. Album wey e say he go drop since June 2013? See ehn, Wande gas find producer wey two of them go gel together. You no see Orezi and Kidominant? Davido and Shizzi? Na that kin thing Wande need. Oga journalist: You may be right. I think Wande needs to take advantage of his endorsement with Glo and spread his music more. Oga Journalist: Na true I dey tell you.

I even  hear say him get songs wey e record abandon with Sarz and Del B. Na the kin producers wey him suppose dey work with be that, no be Maleek Berry. Oga journalist: How you take sabi these ki gist? You don leave your mechanic job? Oga Journalist: Forget matter, na some boiz wey con service their car Agidingbi dey talk am wey I hear.  Wait sef, him no fit go meet Don Jazzy to produce for am and e go pay Don Jazzy money? Oga journalist: He can. But I can’t guarantee that such will happen. You know these musicians can be proud. Oga Journalist: I even say Wande never change him style of writing, say na still same way formula e dey use unlike them Davido and 2face. Oga journalist: That’s true. Wande coal keeps writing the same way, he did it in ‘The Kick’ and ‘Rotate‘ also. You really have a point there. Oga Journalist: Shebi na entertainment you dey write, you no fit interview am and tell am all these things? Oga journalist: I’ve actually tried to do that, but his manager is always saying things like ‘he is not in town; we will contact you once he gets back’. Oga Journalist: na wa o. Oga Journalist: If you have the opportunity to meet Wande Coal, what advice would you give him? Oga Journalist: Make him find better producer wey understand am die. And if he no see, make him dey pay don jazzy for beat. Him na talented black diamond nah. He no fit waste that talent o. Oga Journalist: Oga journalist, make we leave this Wande matter jare, you don hear Pasuma new show for London? E sweet pass all these ‘baby shake’ am wey u dey hear, make I jam am for you. *Michael Abimboye is a Nigerian journalist, he tweets via @mmakesense...  reports/thenet.ng


Comments

Popular posts from this blog

Nkiru Sylvanus returns in "The Voice"

Ray J offers sex tape money to Kim Kardashian and Kanye West as a wedding gift

America and Arab allies launch 50 strikes on terrorist group's Syrian heartland and warns its fanatical leaders 'this is only the beginning'